Wetin be di best diet to maintain healthy hair

Wetin we dey chop dey show for our hair
Wetin we dey chop dey show for our hair, according to sabi pipo

Wetin we dey chop get direct impact on our health for evri levels, from physical or psychological fitness to how we dey perform .

But e fit also influence sometin else, like di shine of your skin or hair.

No be minor matter: abnormal hair loss fit be one of di first signs say sometin dey wrong and we no suppose ignore am.

Dis symptom dey trigger by different causes, like long-term stress, one genetic issue, hormonal change or some kind pharmacological treatments.

Inflammation far away

We sabi say some kind nutrients, like those wey dey rich for proteins, B vitamins, trace elements or some kind minerals like iron or zinc, dey key to hair health?

In fact, disease wey dey cause eating disorders like anorexia or bulimia – wey be ogbonge restriction of calories and vitamins – get strong connect wit hair loss.

Wetin fit no dey well known na some components of di diet wey fit cause hair loss and hunger.

For example, foods wey high for sugar or saturated fat no only dey associated wit di development of cardiovascular diseases, but dey also “stress” and work up our cells .

Dis state dey make di body more open to develop plenti conditions; among dem, na hair loss.

Woman gbab her head dey look inside fridge
Wetin you fit chop to improve hair quality?

Sake of dis reason, many of di remedies wey market dey offer to prevent am focus on di anti-inflammatory effects of some compounds.

To treat foods as important wit dis properties for our table – like oily fish or extra virgin olive oil – and avoid to dey chop those wey dey promote inflammatory state go help, according to dis thinking, to maintain di health of di hair.

Some studies support am.

For example, some show say Mediterranean diet, example of one menu wey rich in foods wey get anti-inflammatory properties , fit get protective effect on hair health.

Stress, anoda major offender of hair loss

Stressful situations wey dey come up for our daily lives dey raise di level of di hormone cortisol as one defense mechanism.

But what if dis “emergency” situation continue long term?

Dat na wia di problems dey start .

Di one wey adrenal gland produce, cortisol dey directly involve wit hair loss .

Obviously, to reduce stress triggers na di first tin wey dey come to mind to keep dis organic compound for normal values.

Woman hold cup and fruits
Healthy diet, nice hair.

We fit help regulate am wit diet?

Yes.

Some kind foods like avocado, oily fish or some kind seeds, wey all rich wit omega-3 fatty acids and plenti vitamins and minerals, fit stop cortisol.

Di microbiota factor

Finally, foods wey don ferment don also prove to get protective effects against hair loss thank you to di regulation of intestinal bacteria and dia inflammatory properties.

And dis na wia di intestinal microbiota, di set of microorganisms wey dey live inside our digestive system, come to play.

Dis microscopic ecosystem directly connect wit health and disease through im interaction wit di nutrients wey we ingest.

So much so dat our microbiota go dey different depending on wetin we chop .

Nutrients dey metabolized or absorbed differently dat one depending on our bacterial population, wey make am dey generate different chemical and metabolic signals.

Dis fit change physiological functions like di stress response , wey relevant to hair health, as we don see am above.

Di richer and more assorted our diet dey, so di community of bacteria wey dey inside di intestine.

We fit help wit di consumption of probiotics , like yogurt, kefir or oda fermented foods, wey get connect wit beta digestive and mental health.

Our hair go also thank us .